Kano Govment Talk Say Dem No Divert ₦6.5bn

You are viewing content from Wazobia FM Kano. Would you like to make this your preferred location?

Kano State Govment talk say dem no carry ₦6.5 billion comot from the state money.

Dis one dey inside statement wey Kano release on Monday, through Govnor Abba Yusuf spokesperson, Sanusi Darwakin-Tofa.

Di reply follow tori wey dey waka for digital media wey talk say Director-General of Protocol Directorate, Abdullahi Rogo, join hand for di money diversion.

Govment talk say every money wey comot get proper budget and clear code for di state fiscal policy.

“Protocol Directorate dey handle important work like logistics, accommodation, welfare and arrangement for govnor movement, and dis one dey involve big money transactions.

Govment still stand gidigba say dem dey committed to transparency, accountability and no tolerance for corruption,” na wetin Darwakin-Tofa talk.

E still talk say Kano State Govment get confidence for di integrity of Rogo, and di administration no go gree make political blackmail hold dem.

“Govment dey re-echo say dem stand for transparency and accountability, and dem dey beg correct media houses make dem no allow bad belle people use their platform mislead or confuse di public.

Govment dey encourage people to follow law, and dem believe say officials fit explain and defend wetin dem do, in line with due process and public service regulation,” e talk.

E still warn people wey dey push dis kain false publications make dem stop, and instead join hand with govment build di state.


Kano Weather

  • Kano

    Sunny intervals

    High: 31°C | Low: 22°C