
Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, don order Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) make dem put Fuji music legend, King Wasiu Ayinde Marshal wey people sabi as Kwam 1, for no-fly list because im break safety rule for Nnamdi Azikiwe International Airport for Abuja.
Di order come few days afta kasala burst for tarmac wey involve Kwam 1 and two pilots from ValueJet Airlines. Di gbege make NCAA suspend di licences of di two pilots Captain Oluranti Ogoyi and First Officer Ivan Oloba. Festus Keyamo, wey be Minister, talk for one statement wey im drop for him official X handle (@fkeyamo) say im no happy at all with wetin both di musician and di flight crew do. Im describe di whole mata as “small madness and loss of control from both sides” wey for even lead to people die. “Even though Kwam 1 people dey talk say nothing happen, di man waka up and down for tarmac and block di plane from move go runway,” Keyamo talk. “Dat kain thing whether na water bottle or alcohol dey him hand na like say you hold di plane hostage. E no make sense at all.” Di Minister still add say wetin happen na serious break of international aviation safety rules, and even though dem don punish di pilots, e be like say na only one side dey collect punishment. “No matter how pesin vex, pilot no suppose try move plane when person still dey front,” e talk. “Both sides break ICAO safety rules. Justice suppose balance well.” Because of all dis, Keyamo don tell NCAA make dem continue di investigation and also tell all local and international airlines say dem no suppose carry Kwam 1 enter flight again. E warn say any airline wey no gree follow di order go risk lose dem operating licence.