
Officers of Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don arrest former Sokoto State governor, Aminu Tambuwal, on Monday over alleged N189 billion fraud.
One source wey dey close to di commission tell News Agency of Nigeria (NAN) say di former governor dey EFCC custody for their Abuja head office.
Di source, wey no wan make dem call im name, talk say Tambuwal, wey be governor of Sokoto from 2015 to 2023, dey face accusation of fraudulent cash withdrawals wey reach N189 billion — something wey no follow di Money Laundering (Prevention & Prohibition) Act, 2022.
Tambuwal, wey be serving senator now, reach EFCC headquarters around 11:30am on Monday, and interrogators don dey question am over di alleged financial crime.
When dem ask EFCC spokesperson, Dele Oyewale, about di matter, e decline to talk.