
Adamawa State Police dey investigate two different wahala wey happen for Madagali and Gombi local government, wey lead to person death because of gbege wey start from house matter.
Police tok-tok pesin, SP Suleiman Nguroje, yarn for statement wey dem drop on Wednesday say di first kasala happen for Pallam District inside Madagali.
According to wetin dem talk, na fight burst between two women – Rhoda Anthony (55 years) and Victoria Anthony (36 years), wey both marry one man wey im name be Anthony Pallam.
As di fight dey hot, Victoria pikin, wey be Ijai Anthony, 16 years old, carry wood knack him stepmama Rhoda for head. Di woman fall for ground. Police for Madagali rush go di place sharp-sharp, carry di woman go Cottage Hospital for treatment, but she later kpai for hospital.
Dem don carry di boy and him mama enter protective custody as investigation still dey go on.
Police yarn say another gbege still happen for Fotta District, Gombi LGA.
Dem say one man wey him name na Idi Buba, stab him own papa, Buba Jelli, for neck and back with knife after dem get wahala for house. Dem rush di papa go Primary Health Care Center for Fotta, but he still die for there.
Police don arrest Idi Buba for di scene and dem recover di knife wey he use for di attack. Di knife go serve as exhibit for court.
Commissioner of Police for Adamawa State, CP Dankombo Morris, don condemn di violence, especially wetin dey happen inside family.
E beg everybody make dem try cool down during wahala, no dey take law for their hand, and always find peaceful way to settle any kind fight.
He still talk say investigation still dey go, and dem go carry di suspects go court once everything complete.