
Popular Nigerian singer Paul Okoye, wey people sabi as Rudeboy from P-Square, don blast new artistes wey dey make smoking look like say na fashion for music videos.
For one hot Instagram story, Rudeboy vex say upcoming musicians just dey smoke anyhow for camera, even before the music start sef, dem don already dey light Igbo.
He write:
“Dear new acts, abeg, who tell una say una must smoke Igbo for camera during visuals? 20 seconds into the video, una don dey light up. Na your choice oh, but make sure say you dey chop better food too.”
Rudeboy come talk say e funny say some of these artistes go spend like ₦50,000 on weed but still dey manage Indomie of ₦1,000 without even egg join.
“You dey look sick. You dey smoke around ₦50k but dey battle Indomie of ₦1k without egg. Under pressure,” he add.
He warn say all this fake swag just to impress camera no make sense. Instead, make dem focus on their health and take care of themselves well.
Rudeboy end am with advice say no be everything be cruise or show — make dem use sense before dem run enter regret.