
NDLEA don arrest Prophet Adefolusho Olasele, wey be founder and General Overseer of Turn of Mercy Church, wey dem dey also call Abbas Ajakaiye, say na him dey mastermind plenty illegal drug wey dem ship enta Naija.
This na wetin we see for the statement wey Director of media and Advocacy, NDLEA, Femi Babafemi tok on Sunday for Abuja.
Babafemi talk say dem arrest am for hin church wey dey Okun Ajah, Ogombo road, Lekki area for Lagos on Aug. 3.
He yarn say NDLEA officers wait for am from morning till evening to finish Sunday service before dem con catch am, as e dey comot the church compound.
He still yarn say dem arrest am, after him don dodge dem pipo two times wen dem nearly catch am, him con go Ghana go hide him head.
He talk say na wen oga of police begin dey find am, after dem catch him two shipment of Ghana Igbo and canna.
He tok say dem hold my 200kg of psychoactive substance for Okun Ajah beach on June 4.
The second one na consignment of 700kg of the same thing wen dem first catch, dem hold for my motor wen dey carry my market on July 4.
He talk say na true say him dey carry igbo and the rest, from Ghana inside Naija through water.